Tuesday, February 5, 2008

Niger Delta and their wahala

This wahala no dey end, everybody dey "task" everybody to do something. MEND don talk say na them attack one kain base for shell come kill three navy men join. Dem don begin their wahala again because dem talk say nobody dey answer dem. Meanwhile one kain comittee for UN, come inspect the whole thing, their own conclusion be say na "trust" be the wahala. Laugh be wan kill me, before nko? Na today dem know say poor man no dey trust anybody ? I take God beg una!

Armed robbers: Na dem don take over Lagos and infact, na dem get Nigeria. Police no even fit battle dem ,all the guns dem, dem talk say Obasanjo brother in law don thief dem long time ago, so now, na hand dem dey take fight machine gun.

Football: Because of that useless match, people dey cry, dey vex, so tey one young man die self! Na wa oh, shebi una see the kain thing wey poor man don dey take serious? na the only thing wey dem get, and dat one self, don kpafuka!

Strike: Dem dey strike for all the courts dem.

Una do well.

2 comments:

TheAfroBeat said...

I heard that some ghanians were killed in Nigeria after the match, any word on this? I heard from an upset ghanian, and was shocked that we would sink to such lows...over football?? Who beg us say make we go embarass ourselves for there before? hiss.

Edirin said...

@TheAfroBeat::you are joking,not that the match wasnt serious but damn, did any1 really expect najai to win. i was backing for them to do well, but i never had it in my mind say they go win

my sista,naija don fuck up oh,this beatiful country, people just dey mess the whole place up, watin sef.

i dont even know if nigeria can ever be revived,sotay people don they fear to go there, abeg oh,i still have faith in them, we should work together and make nigeria a better place.(funny but true)