Monday, February 11, 2008

Ibori and Igbenedion: Dem don waka!

Dem don grant the former governors for BENDEL, bail. Na Ibori represent Delta for prison, Igbenedion na im represent the Benin part. Anyway, dem don comot. Dem say dem don grant dem bail from prison. Me self, I shock. The one wey dem dey there na prison? place where generator, ac, carpet, chef self dey, na dat one dem call prison? Na wa oh! Anyway, dem go dey party dis night sha.

One yeye senator go do "kpali runs". Na one American woman im go marry because of "paper", pikin self, dey the matter.

Egypt win the African cup self. I salute them. Dem try.

Una do well.

2 comments:

SOLOMONSYDELLE said...

This Ibori, na wa oh! Anyway, me sef I dey talk about the situation for my own side. Make you come siddon talk.


How'd i do? lol!

Wordsbody said...

Waffy Girl, dis na di reason wey a no dey wan read Naija news sometimes. Na so so all kain craze twists dey happen for inside news.

Yes, Egypt don try. Dat one at least no be prison-generator news.

You dey do well for hia, too.