Wednesday, August 29, 2012

No medal for Olympics self, presido self get diet plan.

Na so Olympics 2012  done come, done go, self. For all the whole sports, Nigeria no manage to get even one common medal. People come dey vex, dey complain. Na im sports minister self write long tory for the matter, dey explain why no medal reach our hand. 

Presido wife self don become permanent secretary for im state. Na so one governor just dash our first lady job for that side, say the woman self must to chop. People come dey cry fowl, say no be better thing be that. First lady say e no concern am, make people cry self, im self, must to be civil servant by force.

Boko Haram still dey terrorize people anyhow. Nobody know how dem wan take solve the matter.

Light still no dey. The oga kpata kpata for the light matter just vex comot, say im no do again.

Dem don release the diet plan of our presido. Na these kain things the man dey chop: Fish pepper soup, bread, yam, plenty fruit and vegetable dem. Na im personal person na im say make im realease this diet plan so all those rumour mongers dem wey dey internet no go dey say na so so ogogoro the man dey drink.

Una do well.

Friday, January 20, 2012

Petrol price don increase, Boko Haram everywhere.

Na all of kinds of wahala na im our country Nigeria begin this New Year with.

Oga president, Jonathan Goodluck say im must to increase petrol price by force. Na im everybody come vex anyhow. The youths dem enter street, say im must to reduce the price. Labour people come enter the matter say everybody must to strike. Wey dem come strike finish nah, come do meeting here and there, na im labour people say matter don end, say make people just swallow am as e be, say na so life be.

Boko Haram dey cause wahala anyhow. Dem say dem no like education matter. Say dem wan just read koran dey go for their life, na im dem begin bomb anyhow say dem dey vex for the matter. Dem come bomb different church dem for the north, come kill plenty innocent people. People wey dey live for another corner now, for the south of Nigeria come carry the matter for head. Dem say all dem muslim people must to comot that area. Police come do small work,come catch the leader of the Boko Haram people dem, everybody come happy. Now nah, dem say the guy don escape. Dem still dey investigate the matter.

Happy New Year.

Una do well