Thursday, January 24, 2008

Wuru Wuru for Senate House.

All sorts of wahala. Dem say people wey dey do 419 self dey the house. Na so dem come dey fight, dey open each other nyash anyhow. Dis my country, una never chop reach?

Igbenedion: Dem don carry the wayo man put for court, dey read all the bad things wey im do dem. The list long from here till jericho!

Presido dey Obodo oyibo: The man and im wife just dey enjoy life for Switzerland, dey chop cheese and chocolate for that side.

Una do well.

2 comments:

Wordsbody said...

Waffy Girl,

Na how many blogs you get sef? Me a bin dey enjoi dis ya news for pidgin weli-weli. I go dey come here come read dem dem chop chop news regularly.

Waffarian said...

My sista! na aproko job oh!