Wednesday, January 28, 2009

Animal self no dey escape law

Dem don arrest one goat for kwara state, say the goat na human being wey turn to goat. The police people say na as dem be dey chase the human being na so the person just put back for wall, turn to goat. Na im dem bundle the goat go police station. The goat dey prison as we dey speak.

Presido don go holiday. As New Year land finish, na im presido carry im legs go do enjoyment.

Dem don fine one oyibo company "Halliburton" say dem dey give our Nigerian government people dem, plenty plenty bribe so make dem dey get all the better contract dem.

The Governor of Yobe state don die. Dem say na leukemia na im kill am.

Una do well.